Bobi Wine Kyaddaaki Abayimbi Bamwegasseeko, M7 Kati Bamwevuma

Votre vidéo commence dans 20
Passer (5)
IA Yourtube Master rapport

Merci ! Partagez avec vos amis !

Vous avez aimé cette vidéo, merci de votre vote !

Ajoutées by admin
69 Vues
Uganda police force confam dis report for one statement wey dia Public Relations Officer, SP Patrick Onyango bring come out today;

"Three pipo na we don arrest in connection to unauthorised concert wey dem hold last night in Ddungu Resort inside Munyonyo, Kampala City."


"Those wey we arrest na; Ivan Ddungu, di manager of di place where di concert dey hold, Omah Lay di musician and Prim Kasana, di events Manager, wey carry Omah Lay come di kontri to sing."
Police say di organizers of di show disguise say dem dey do lunch and dinner event, but later on for night dem start to dey invite artistes;

"Allegation say di organizers of di show disguise am as lunch and dinner event, but later on at night dem start to invite artistes to perform.

"Di suspects dey detained for Katwe Police Station and dem go get charged with doing acts wey dey likely to cause di spread of infectious disease, wey be corona virus."

"On di beginning of di COVID19 pandemic, di president direct say make dem stop music concerts and di directives still stands.

"We condemn di act of some selfish individuals, wey dey bent on violating di directives on CONVID-19 to make money and risks di lives of many Ugandans."

Ugandan police force beg members of di public to obey di Ministry of Health guidelines on coronavirus.

Meanwhile, #freeOmahLay don dey trend for social media as fans of di artist dey react to di news of im arrest.
#BobiWine #OmahLay #NUP #Artists
Catégories
Divers News Artistes

Ajouter un commentaire

Commentaires

Soyez le premier à commenter cette vidéo.